THE LORD IS MY SHEPHERD IN PIDGIN.

THE LORD IS MY SHEPHERD!

THE LORD IS MY SHEPHERD!

I take style find dis psalm for pidgin for http://www.nairaland.com. I even hear say dem get pidgin bible. Mek your week surugede IJN. Amin!!!!

PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH

1. The Lord na mai Shepherd, I dey kamkpe

2. He make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi Thermacool.

3. He panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness for sake of Hin Name.

4. Walahi! If I waka pass where arm robber, 419, and juju people borku, come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so them dey like back bone dey comfort me.

5. You don prepare Banga and starch make I chop. All my enemies dey look anyaya. You rob me for head wit Vaseline Intensive Lotion. My cup na Ogunpa River wey come overflow hin bank.

6. True, true, betta life & mercy go gum my back till I quench. And man go tanda for God house sotey sotey from Lai lai to lai lai. GOD ALMIGHTY, NA YOU BIKO. AMIN!!

Posted from WordPress for BlackBerry.

2 thoughts on “THE LORD IS MY SHEPHERD IN PIDGIN.

Leave a reply to cheta2013 Cancel reply